Big institutions no dey play: Spot ETFs and big companies still dey accumulate quietly whenever retail traders dey fear. (
https://bitcointreasuries.net/)
You don forget say wetin make the crypto red na say institutions dey sell heavily, and na the same institutions you dey put hope on say them go deliver you to regain price. So make institutions no sell, make them just dey buy? E get topic I come across wey dey vex for institutions say e dey hurt crypto.
Wetin me I know be say, whether institutions bulk purchase or not, crypto go reach en milestone, I no care about institutions like that, what I care about is demand and supply affecting the price positively and negatively.
No be all institutions sell, moreover all dem no go fit sell at once and the ones wey sell only sell some portions. With time the selling pressure go end and by them other institutions go done buy enough when the market been down and continue to dey buy too as eh dey gradually recover.
That one na sure, even though institutions get their roles to play, if dem no bulk purchase like you call am, eh fit slow the progress of Bitcoin. However, Bitcoin still get potential to go higher than the ATH regardless.