As una dey comment for thread make una still try to compete for the contest. I see say person use indomie do pizza lol I no sure if na because of that one make am lose the contest. Abeg make we try follow all the rules of the contest, no enter the contest with more than one account and no vote for yourself. Them don catch many accounts for cheating contests so take note.
Gbam! Na so e be, we comment, we go dere go bomb, nothing more. We no fit just Sidon dey look na, no way. 9ja must show face, even though say Dem win am, but Dem go no say we enter, shake the table small. I even believe say we go toast better pizza give Dem, Dem go confirm. No be pizza we dey chop here everyday like oil r? Nothing dey sup. We go enter, we go partake, particularly me, I dey full time