<<  >> (p.87)
    Author Topic: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread.  (Read 1534570 times)
    This is a self-moderated topic. If you do not want to be moderated by the person who started this topic, create a new topic. (41 posts by 1+ user deleted.)
    Nathrixxx
    Full Member
    ***
    Offline Offline

    Activity: 280
    Merit: 157


    View Profile
    October 13, 2021, 05:35:13 PM
     #1721

    NEW TOPIC: Senate bows to pressure, says INEC can transmit elections electronically

    Las las dey dun pass the bill oh and this wan happen on Tuesday, this election wey dey come go sweet die. Wetin una think, the manipulating go dey easier now or their yansh go open finish as e go hard for dem to set compass

    E for make sense o if dey go folow d nomal protocol but come to tink of it, wat if dem go bring one manipulated result come dey show us say na wetin we vote be dat as u knw say we d masses no get access to dem computer, or better still as pesin dey vote make d results dey show immediately on data and d same day dem go announce d results and winner, if dem no go give room 4 orijo walai e go make pass bcos for computer too orijo plenty yanfuyanfu.

    Anoda tin be say dem fit do d election vote as pos take dey operate now, after you vote ur result among other votes go just print out immediately, see if we no go use awa naija orijo e for make sense, or make revolution com make all dis our old leaders dem die all make new political era begins.

    Meanwhile i bin dey tink saw na south west dem wan hand over d nex election for presido and dem people for Yoruba land no want Tinubu and com dey claim no election com 2023 in South West, agitating for "Yoruba Nation" even d Tinubu sef dey London since and d old papa sef no dey kampe for bodi o e bin seek with several operations wey he don do.

    4d election mata gbege go plenty o bcos pipu dey yarn say no voting again of wich me a beliv its not possible but APC mata 4 naija don finish after buhari.
Page 86
Viewing Page: 87