Welcome on board, Yourhomeboy. Well, we go like know what part of Naija wey you dey to start with. Concerning Merit, I believe the koko be for you to make posts wey you believe someone go read and e go help the person resolve one situation or the other. Just be yourself (post anywhere you like) and with time the merit go dey drop. Meta and the Bitcoin technical support sections are good places in addition because na there the big boys here dey like gather.
Bros, na d fear wey me particula dey fear 4 d forum; say if i go 2 meta, dey go hurt me down; either d big group side or d small group, u know dem. Also, person tell me sey, meta section na 4 big boyzs who kno how 2 do politics, and sometin wey i dey fear again b sey, tagging start from dere, so, am afraid 2 go dere.
See me now, i don dey grow smal smal 4rm Newbie to Member

bros BrainBoss don tell me 2 b careful d way i dey go about attack becus dem de big boyzs fit do me strong tin nd i hear dat tin 2 times. We know sey meta na 4 attack while i go con go dere 2 risk my account?
Make Yourhomeboy start 4rm were i dey get my little fair share 4 now, wey b Beginner section nd him no go regret aam at all.
Yourhomeboy welcome 2 d forum were rules nd regulations work 4 all. I see u 4 service section wit ur service, pls make u dey very careful becus here no b like Naija ooo.