If true true I dey eligible, I go vote sharply.
Your suggestion to use it as FAIL OF THE YEAR instead of discovery of the year make sense.
I go like make our ogas we dey here for years before we come put mouth for this talk. Because,
African Proverb in pidgin talk say "Something wey elder sit-down for chair see, pikin go climb coconut tree e no go see am"
Brother, no body be pikin for here ooh, we fit get bosses like CryptopreneurBrainboss them, like mpamaegbu them and the rest, but that one no mean say other maybe newbies members na small pikin, so all I dey try talk be say, make you no go the look down on yourself say you never reach, general knowledge no be by rank on bitcointalk ooh....😜😜
Anyways, hi brethrens, been a while here, sorry for being a run away solider, e get as things been be ooh, una know say be every thing person dey make public, but all the same, I greet everyone here both new and old.. Una weldone sirs and mas.