Abeg, do-do men and women way group up for here I dey hail una o. Happy new month and Sunday to all of una. How e dey be for una side na? Hope say everything dey go jejely. No wayo shah! Abeg, to keep up with English for the whole section of the forum no easy. Me I go like make we loosen up for here. I no say everybody no dey here pigin for here but, the plenty people way hear and understand am, make we promote am, pigin na our culture and that's what Africa is mostly about. Plus, promoting our unique African culture go bring us closer as per the unity. African culture way sweet wella!
Na our own small community be this o, na we dey here, so make we dey like say na our land be this. No plenty big big grammar for here. Loosen up, give me correct pigin way go make me laff. No be say, you no go make your point o, or pass message with better English for the rest way no understand pigin to follow up but, you go use your head and promote the vernacular abi mother tongue once-once. Abeg, if you sabi the pigin wella, make una follow me yan for here abeg, pigin-english sweet o. Abi the plenty comedy for we country no be when them use pigin direct am na em you dey enjoy am. Ah-ah! Too much English wan kill person for this forum. I dey see say some people dey run am already and I dey enjoy una, I no go lie. Na for people way still dey hide am to burst out o. Give me the wazobia, na so I like am, raw and original. Make we level up for here abeg.
I Preach One Africa,
I Rep Africa,
Ur Official 9Ja Guy.
Lol... Guy, you self ehn.
All these your epistle never pass those englishians own

Came down, you meet us for this thread. We dey holam tight. Nothing mege. Onwe hu Ihe mega ayin. Nothing dey bite where you sleep.