Lol d revace fit be like molue wey dey turn 4 one small Ajegunle street. D molue fit take 5hours try 2 turn & enta gotta

. If area bois push am come out, u go jus see d molue conductor advisin his driver say mak dem go anoda place go turn.

. Laf don finis me 4 dis ya xperiense. Mak nwa guy kol ur bori 4 u
I mean am o, na as e be me I dey tell una so. I know say the market get as e be, like when you dey expect am to buy, e fit turn against you almost, that one dey.
But then, na via the plenty lapses for your analysis but then, watin fit save you too na your account size. If you be man with large account size, you fit dey patient to hold the trade with hope say, e go reverse soon but that too na risky move o, via say, e fit turn against you con dey create new higher highs instead of lower lows.
If you analyze trade well to be oversold using RSI and you dey watch the kind of power candle stick, dragonfly doji, harmer, hanging man and all those signs of trend reversal them within a period of consolidation under four hour time frame though, you get to dey switch time frames to clarify yourself. Then, even when e still go against you, you get just hol small with your eye on the direction your moving average dey tell you, na the best way to ride or catch trend early be that. Your equity go sure.
Abi you never see am say, na plenty getting out of trade on loss dey chop you finish much much... And as you place trade ecf, na straight up minus you go dey see. Although, no be all trade you go hold shah, e get some way you just gat commot immediately but, na for you to know them be the matter.
But all na base on sabi shah and you way dey trade kwanu. You get find technique way go work for you.