Buhari don meet with APC governors today for Abuja and em talk many things but all the things wey him talk, I go point out some here:
1. Baba talk say make APC governors support him to choose who go succeed am. This one show well well say Baba get interest to produce who go replace him.
2. Baba describe the kind person wey him want to succeed him.
3. Him say he go like person wey dey acceptable to the people.
4. Person wey sabi dey core value of APC
5. Person wey go fit unite people.
6. And before now him talk say he go like hand over power to a younger person.
All the above qualities no match Tinubu atol and him kuku understand shaa
Anybody way get eye go see say Tinubu no be Buhari candidate, na Rotimi Amaechi be the chosen one.
Before I been dey talk say I no go involve myself for politics because of the things wey don hapun in the past. But I come reason am again, if our votes nor dey count as many of us believe, why the northerners dey always go back home during elections to vote?
Thank you my brother for understanding this mystery. E simple to understand but some people no wan understand the game. Make I just update us wetin they happen currently for the country because I dey get first hand information.
1. Buhari want Amaechi to succeed him.
2. Tinubu no wan give up for Amaechi. Tinubu no want Amaechi at all and Tinubu no want him son (Osibanjo) because him feel say PYO betrayed him. If Tinubu change mind now endorse PYO, na wetin go fit make Amaechi get problem.
3. PDP and Atiku know say na Amaechi be Buhari candidate, so dem dey wait make APC give him ticket, then them go use Wike as running mate to Atiku so that him no go fit support him brother Amaechi.
4. But if APC no give Amaechi ticket, Atiku go use Okowa or Udom as running mate.
5. Jagaban don make him plan B finish to shift go SDP incase APC fvck am up.
6. Northern cabals being the king makers want Atiku or Amaechi as the next president.