I nor know if una dun end discussion for the other matter wey person start, I been dun dey look out for person to start this discussion for this pressing matter wey concern all of us.
THE MATTER NA THIS OIL THEFT. Nor be even the one we know i dey talk about wey be the illegal bursting of pipeline and refining but the ones wey the bigger boys dey involved in wey be setting up illegal tapping point and smuggling the oil stolen out of the country in ships. Make una observe this picture well and see the expertise involved

Do you think there is anyway the people behind this oil theft can be able to pull this off without the help of the government?
I go give you real life and first hand information from wetin I done see no be Dem say Dem say! This nah first hand information as a waterside Bwoy I be. For the Okrika side, this pipe them Dem no dey inside ground for some areas, I for share pictures but I no dey okrika currently. E dey sup without Government notice even Nnpc no dey know for like one month.
For my secondary school days, I dey always dey duty post as prefect, so I witnessed army pipu and NNPC officials come around my school coz e dey near swamp area, niggas tap pipe from those pipe to that our school side, them say ( NNPC) say them dey get shortage and them come use them check to see if nah true and indeed nah him. Pipu weh do chemistry go know say this pipe get wetin Dem dey use check flow of the oil, ( I done forget the name, I go edit am immediately I remember ).
So nah so them cramp about ten to fifteen niggers, some done return from prison Sha, some still dey. Government no dey know, this days them dey even use bad boys dey catch other bad boy's. Na real cap I drop, I go drop pictures if person I tell to share me pictures drop am.
Them get tool's Dem deybuse run am and nah for zero zero hour's ( 2AM ) them dey move matters ( oil )