The Voters card sanitization and awareness campaign this period make sense wella, I like the fact that the youths are now fully involve in politics now. But my issue me say no be to register for PVC come keep am for house oo, I know say most of the youths nogo gree come out to vote that day due to fear of oppression from political thugs. INEC must still provide voters some kind of security I think that's the only way to get maximum result.
D awakening way com dis period eh, e no dey lik anytin way 9ja don xperience b4. Dis na 2 shw complet trust 4 INEC nd d voting system. Our hope dis time be say, mak INEC no con betray us bcus na dere hand e dey 2 decide who win despite our vote.
But, on a serious note, I lik d way tins dey go nd dis day born out of d sufferin way we don endure for yrs. I no doubt say, we go see youths plenty 4 polling unit dis time, after all, dem thugs na stil youth kwa nd d diaspora wth some pple way want change dey ready 2 join bodi wth INEC to ensur security of polling unit nd credible election.
Men dey remember wetin don sup. The spirit of Endsars and Lekki Killings dey alive. We are not giving up. Men are into this seriously.
I no dey talk say Peter Obi na messiah, but wetin I dey talk be say the other two options no go well for us.
For sure say everybody get choice but this time around, I feel like everybody wey mean well for Nigeria, no be only youths, go vote Peter Obi. Wetin these men wan tell us again wey we never hear?
Dem go work road for us abi? For this 21st century our leaders still dey campaign with road and electricity. Mehn! We have been raped.
Today, Wike son graduate from UK University with 2.1 for law why some bright stars here dey wait for ASUU.
Ekweremadu dey fly UK to save daughter while millions of our daughters dey die for poorly equipped hospitals here without making headlines.