Reminder 📢
INEC Will Opens Portal Today 14th September 2022
INEC portalDear Nigerian youths, make we no misuse this opportunity biko. If you have the requirement please register as early so you go contribute to free and fair election.
How to take apply for INEC Adhoc staff for 2023 electionsThings wey u need get intact
- Email wey u dey use now
- phone number wey u dey use now
- your own account number.
- white background passport wey never Tey, abeg make he no pass 5MB for size
- Two people for referee with them info's (email and phone number)
- ID number wether na staff ID or Student own
- you fit use your Nysc call up Number even if you Don finish but make he never too Tey like 2018 come today.
-PDF copy of the highest qualification wey u get
- any Identification means wey u get for. jpeg format.
Abeg when you dey register check wella make you know position wey be your own.
Dem go also require BVN but make u no fear. Them just wan use am make peopl no go register plenty times
And abeg cross check information wella because dem go validate am from school/referees
©INEC²²
Abeg make we gather go register before them go go put yeye people for government for us.
GOD BLESS NIGERIA