EFCCs Raid Black Market Forex Dealers for Abuja EFCC go burst bureau de change guys for AbujaEFCC go burst bureau de change guys for Abuja, Dem dey vex say na them be part of the reason wey dey make our naira dey fall anyhow because dem dey hoard or still dey do transaction with the U.S dollar even after dem don warn dem. EFCC talk say dem nor go stop for Abuja. Dem say dem go still cari the raid go other states for we naija wey all this bureau de change guys still dey like for Kano, Lagos, Port Harcourt, Enugu, and Calabar. As e be now, dem don dey claim say na the EFCC intervention way don make our naira rebound to N650 per dollar as at the time dem write the tori.
How true is it, do they mean say the black market forex for Abuja na only dem for the country make the naira dey fall? Besides the way I see am be say raiding the bureau de change guys na only temporary solution. Dem go still organize themselves and continue their business.
This one weh Meffy, cbn and fgn de do na just waste of precious time and resources. just like dem shift all the blame go put for abokifx website, na so dem de do again with this invasion. If dem like make dem arrest every bureau de change weh de the countri, e no go solve any problem.
Govt, Meffy and cbn are the main causes of inflation;
1. meffy de hoard dollar for over 5 years,
2. meffy restrict import fx to less than 1% of the entire nation population
3. meffy limit fx to 100$, then 50$ for a nation weh de flex local atm anywhere in the world before apc came to govt
4. meffy con say again say deposit ur $ into domicilliary and get free naiira which con lead to devaluation and demand.
and as economics talk, if demand de increase daily, and supply no reach, human de tend to find alternatives; when alternatives no fit supply for the present demand scarcity sets in; when scarcity de, inflation go de and na wetin we de face for the contri be that
make meffy, cbn and fg stop minting naira, allow competition and stop hoarding $.
locking up bereau de change will only make the devaluation faster (funny enough, they know this, so na intentional game)