Omo bubu no send anybody o like this him want wait till his tenure is over na wetin make i like away pipo them for resign with the remaining 10 months of his seat but we country no dey like that oo, them go wait till everything empty whether them go still get small chance to loot more before running away. This one vex me badly
Him cef do see am say, d seat no easy to seat down on top nd d kontri too hard to manage, na why we no need anoda sick old man to seat down for dat seat and dey run kontri way dey on d verge of collapse frm sick bed. I beliv in Obi evn if I no see qualification nd If na suffer dem say e wan bring, I don suffer watin I no xpect frm pple I bin hope to bring change so, e no go mak any difference. Obi na d only tin way gud 4 dis we kontri now nd d truth be say, e go eida bring better on a broad scale or e go mak am bad on a broad scale way b say, evn dose way dey seat go feel am. Dat na to say, e go touch evrybodi.
How can kontri lik dis 4 Africa go shut down schl 4 6months bcus govmnt nd ASUU no fit agree nd evn d ASUU cef, dem get wahala. Na evry time dem dey do dis tin.
Bubu way dey cry touch time so, e no resign o bcus e wan collect en last moni to use settle en children life becus en own down finish nd to use blind EFCC eye.
Mak we get our PVC nd carri ourcef com polling unit.