Lizard wey fall from High Iroko tree land for ground, if nobody salute am him go congratulate himself.
Even nobody blows your trumpet, make it aloud yourself.
Your cruse dey always gimme joy, @Mpamaegbu, na man you be.
Una cruise too follow dey give me correct joy. One love my people.
Na true with that your Alangba proverb. But the problem sometimes go be sey those wey nor understand fit come begin talk sey we dey boast like that.
Because say lizard the always nod Im head no mean say things de alright
Meaning: You can't judge someone by his/her appearance, everyone's got a disturbance in their mind.
Chai! This one na very good lesson wey e suppose teach us. I gbadu am because na so me I dey always take look at life o. Nothing complete for everybody side. That man wey you dey envy also get im own wahala.