Proverb: when corruption favor person e go say na connection
Meaning: Human being go only call something bad when e nor dey work for am
Dat na true. But sha nor be every connection dey be through magomago oh.
Proverb: Small snake wey one person see fit turn to python.
With dis your proverb, I can confirm sey you be Igbo. Our people nor dey joke with dat proverb, especially when dem wan judge matta for community or elsewhere. Dem go want make d accused chook mouth for the matta and explain them own side of wetin happen.
Meanwhile, make I drop una one.
Proverb: When eye dey cry, nose dey follow cry too
Meaning: if you really dey close with person, watin dey worry am or happen to ram, e suppose happen or wayh you too.
Na so e bi.